Nigeria Islamic police dey catch meners wey no dey fast for the Ramadan
Aminudeen talked the BBC sey dem retained seven men then 2 females who act like dem nor know sey the Ramadan fast start already.
Businessman promise woman marriage; he no do; and court say make he pay the woman GHC200,000.
Another side of the matter be sey, na the man dey abroad wey he tasked the woman to supervise completion of e six bedroom apartment as he dey send money.
Parliament approves GH¢2.9 Billion for Medical Fund wey dem dey call “Mahama Cares”
Apart from supporting meners wey sick, dem go use the Mahama Cares Fund to upgrade selected health facilities so sey they go fi provide advanced medical care.
import foreign women make dem born give wana country-South Korean Official talk
The man’s suggestion come at the time wey South Korea dey struggle with the lowest birth rates in the world. This could cause dema current 50 million population reduce to just 25 million in 60 years.
KNUST student fall from e hostel second floor and died
A student for Kwame Nkrumah University of Science and Technology (KNUST) fall from e hostel (wey dey outside campus) second floor and died.
Over 98% of Ghana’s Land No dey Title Registration System
This system of registration only dey show land document deals but e no dey give legal guarantee sey the land belong to one particular person.
Google dey partner Ghana to have Twi, Ewe and Dagbani AI Tools for wana Education system
Minister for Education, Mr. Haruna Iddrisu come talk sey dem dey plan how they go fi use AI and other IT tools to make education better for Ghana and in other African countries. For e Facebook page, on Friday, January 23, 2026, the minister share sey he then the Vice president of Google discuss the […]
NPP nuisance: Manasseh A. Awuni take free advice give NPP micro minority for parliament
But this no mean sey everyday biaa dem for turn themselves into tiktok video content creators and take dey disturb wana ears with things no dey hia plus things wey no dey make sense at all.
SHS boys beat dema teacher; court fines them GH¢15,200
This incident happen for the school inside, according to some reports, students dey rep exams and that teacher dey monitor them well well sey nobody go fi copy.
Dem dey sell Metro Mass Buses for Mere GH¢2,500-Deputy Managing Director of Metro Mass Transit
The man talk sey metro mass get chawo problems. Some bi say most of dema buses make too old. They also no dey get cash wey go help them put the buses in good shape.
Recent Post
- Why Are Surgeons Called “Mr.” Instead of “Doctor”? The Fascinating History Behind the Tradition
- National Scholarship Opportunities in Ghana: How to Apply Successfully
- Job Interview Tips: How to Impress Employers and Increase Your Chances of Getting Hired
- How to Write a Modern CV That Gets You Noticed
- When Will the Next Nursing Training Admission in Ghana Begin?
Teacher go fight plus female student for Nyinahin Catholic SHS; Police arrest am
But this days di33, things have changed paaa ohh. In the past, ebi unthinkable for a student to even talk back when teacher dey floor dey talk; not to even think of fist fight. But the teacher too; what’sup; how you go fit throw blows plus your student who san be female? Aah well!
June 10, 2026|1:12 pm
Bernard
Police go arrest 4 SHS students in Ada as dem issue threats for social media
Police go arrest 4 students of Ada Senior High Technical School as dema video to harm other students go viral. In the video, boys dey brandish cutlass to show how they wan wound dema own colleague students for campus.
May 24, 2026|4:17 pm
Bernard
CR: Another accused person allegedly kpai e bodey for police cell-People Vex
Police go arrest Mr. Emmanuel Cudjoe on May 10 after e girlfriend go report sey he chop e 11-year-old stepdaughter.
May 14, 2026|4:37 am
Bernajis