
NPP minority matter dey come box people dema mind and if dema leaders no tap to see how dey go fi change dema tactics, dem go come dey like Agya Koo concert movies-Ghanaians no go take them serious at all.
Every bro wey dey honest go gree sey e bi Akufo-Addo government wey make things difficult for the country inside in past eight years of dema leadership.
Read formal English version of this write-up; click here
Even some of dema own people for NPP dey talk am plain plain, though some dey talk out of selfish interest.
John Mahama come chop president again wey make things cool down and things for the country come make stable. E check like the president dey listen when meners complain and dem make ready to do things wey dey hia the people.
Minority do yawa with dema small number. It make dema matter unserious for the parliament inside.
It doesn’t mean sey dey for shut dema mouth. If dema votes no go fi do foko, dey go fi use dema voice do something; but dey for do am in a manner wey sense go dey inside.
Ghanaians taya the NPP minority but dey go fi dey the government e top to do the right thing; and this go fi help them slowly win back the heart of Ghanaians.
They go fi explain to Ghanaians mafia things the government dey do or wan do. Things like why Sammy Gyemfi Goldbod dey make losses.
But this no mean sey everyday biaa dem for turn themselves into tiktok video content creators and take dey disturb wana ears with things no dey hia plus things wey no dey make sense at all.
If they continue in that line, people go yawa them more as the micro minority wey dem truly be.
E be true sey some journalist go carry dema mic give them so sey dema noise go go far but that be what go dey annoy people more and they no go take them serious; even if they get something sensible to say.
The U.S revise dema travel policies wey affect 75 countries, including Ghana. Norr the minority go organize a whole press conference wey dem condemn Mr. Ablakwa, the foreign minister sey e bi he cause am and so make president Mahama sack am from office. But it make clear sey the minority rather dey do dema body yawa with den kind of behavior pass everybody or Mr. Ablakwa.
It’s still dey early days yet, but many people dey feel the NDC government and everything dem dey do to make things better dey open wana eyes to how low NPP take the country go down.
All these dey make things hard for anyone who wan convince Ghanaians sey they make mistake by voting into power NDC.
A woman wey left man secof he no dey do the thing well, wey chairman wan still disturb the woman sey she nor know what she lost, that woman go laugh and label am funny Bob Kala if her new man dey give am better for bed.
Just as every government dey do, e no go keep long wey NDC and dema appointees go start dey misbehave. NPP MPs get fine opportunity to hold the government accountable secof they get access to documents.
But we all dey remember the yawa things they defended and e go hard sey we go take them serious if they continue to vex people with the things dem dey do now.
This be what Mr. Manasseh Azure Awuni, that respected journalist known for exposing rots for the country inside talk on his social media handle on 21ist January 2026.