
Police for Ashanti Region go arrest one teacher wey fought plus a female student for Nyinahin Catholic Senior High School. The fight wey kpai between them was recorded and e go viral for social media.
The suspect be one 39-year-old Eric Buernortey Apaflo and police meners go catch am on Monday June 8 around evening T.
Read this article in formal English; click here
The police Public Affairs Unit of the Ashanti Regional Command come release statement signed by ASP Augustine Antwi sey dem go arrest the teacher secof dem get report that he go fight and beat a student called Patience Chibu. The girl be 18 years.
Initial investigation come show sey Mr. Apaflo be the caretaker of the school’s hostel. Apaflo go the hostel to check as boys and the girls dey misbehave for the hostel yard inside.
Ebi there wey the fight kpai between niggarman and the student as confusion come the issue inside.
The matter come bore the students and some start dey throw stone at the teacher. Dem talk sey some even go organize boys for town to come beat up the teacher for the school hostel there.
Ebi police meners wey quickly come the matter inside to put everything under control and to stop more fight.
Police carry medical report form give the student to take go hospital for medical examination and treatment. For the teacher di33, he still dey police cell as dem dey investigate the matter more.
Police talk the public to keep calm and people for nor use violence to settle matters.
But this days di33, things have changed paaa ohh. In the past, ebi unthinkable for a student to even talk back when teacher dey floor dey talk; not to even think of fist fight. But the teacher too; what’sup; how you go fit throw blows plus your student who san be female? Aah well!