
One court judge come disclose sey about 98% of land wey dey Ghana no get proper ownership registration and that be what dey cause issues of buying land like the land-guard problems for the country.
Read formal English of this article: click here
Justice Alexander Osei-tutu talk sey only small portion of land for the country dey under land title registration and that be what give stronger legal prove then ownership over land wey somebody get.
The man san explained sey only few districts wey dem they register land properly and dem all dey Greater Accra, parts of Kumas, then Kasoa side.
Outside these registration districts, land transactions all fall under deeds registration system. This system of registration only dey show land document deals but e no dey give legal guarantee sey the land belong to one particular person.
Risks Associated with Deeds Registration Justice Osei-Tutu talk sey the problem for this deeds registration system be sey, they go fi register one parcel of land multiple times for many different person dema names and that be what dey cause court matters, land-guard issues den things.
According to am, deeds registration only dey give evidence sey some bro submit land document but that no dey sheda give proof sey he be the rightful owner as in the case of title registration which dey give state guaranteed title or ownership.
Call for Urgent Reforms
The judge call on the government and meners wey dey land agencies to open more registration districts for more regions to improve proper land registration.
They also for educate the public how they go fi acquire land properly without wahala. This go help protect meners land properties and reduce all the land-guard and court issues wey dey worry people for the country.