
They go find one senior police officer, DSP Rockson Gyasi dead bodey for dema family house at Akweteyman on Friday March 13 2026 and dem dey investigate secof e check like e no be natural death he die.
The officer e wife, Mavis Boateng wey go find e husbie lifeless body for ground in a pool of blood around 5:am and she go report for Tesano Police Station in Accra at 5:46am; according to police report.
Read this news in formal English: Joynews
The officer e station dey Tsito for Volta Region but he go visit the family for Accra on Tuesday March 10 and the incident happened.
As police arrive for e house, dem see sey he hurt seriously for e 2 cheeks and e pistol dey kitchen stool top just beside he dead bodey.
Initial investigation show sey the day the officer reach Accra, he start dey send e wife some strange, strange WhatsApp messages which suggest sey the man already planned to commit suicide. Some of the messages he sent be: he was “going back to where he came from.”
Investigators for the police headquarters take photos of the area plus the gun then the text messages for further analysis.
Dem take the body go Police Hospital Mortuary for Accra for post-mortem examination.
The police people talk sey dem go update the general public on whatever further info dem go get on what actually happened for this sad matter.